25 Jenuwari 2025
Di Seychelles passport na di most beta one for Africa. E fit allow pesin waka go 156 countries without visa, na wetin di latest Hensley Passport Index tok.
Southern Africa countries dey top di list of di strongest passports for Africa, as dem carry eight out of di first ten positions.
Di strength of passport na how many places e fit carry pesin go without visa for di 227 destinations wey dey di world.
Mauritius passport dey second for Africa, as e fit allow pesin enter 151 countries. South Africa passport dey third, as e fit carry pesin go 106 countries.
Other African passports wey dey di ranking na Botswana, Namibia, Lesotho, Eswatini, Malawi, Kenya, and Morocco own, one by one.