POLITICS
2 minit wey yu go read
Biden: Di Gaza issue na one kain strong wahala
Di President of United States, Joe Biden, say e no be true say Israel go fit keep dey stay for long time if dem no dey consider di Palestine issue and di security of di Palestinians.
Biden: Di Gaza issue na one kain strong wahala
Biden di Gaza issue na one big wahala / AP
17 Jenuwari 2025

Presido Joe Biden for America don do im last TV interview wit MSNBC news channel, wit Lawrence O'Donnell as di host.

Biden tok say di mata of peace for Middle East, especially di Gaza issue, na one kain strong wahala. E still add say e don do plenty work to make ceasefire happen for Gaza. Even though e dey near di end of im tenure, e happy say ceasefire don dey ground.

Biden yan say Israel suppose look di Palestine mata wit better understanding for di sake of their security. E talk say, "E no go possible make Israel dey exist for long if dem no consider di Palestine issue and their security. E no fit happen."

Biden call Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, im "friend" and e tok say, "I dey always remind my friend Bibi Netanyahu say dem gatz find way to address di legit concerns of di big social group wey dem dey call Palestinians."

Biden make am clear say as di kasala for Middle East dey continue, e no go easy to avoid di risk of regional war. Na why dem dey support Israel strong strong, but at di same time, dem dey try stop di fight.

Biden also tok say Iran and Hezbollah don weak pass before, and e believe say dis one dey very important for Israel security.

DI SOURCE:AA
Check out small sample of TRT Global! Share your feedback!
Contact us