BIZNESS AN TEKNOLOJI
1 minit wey yu go read
Fuel wahala fit happun for Nigeria as tanker drivers strike
The tanker drivers declare strike because say Dangote Refinery wan use 4,000 new trucks wey dey run on gas to carry fuel.
Fuel wahala fit happun for Nigeria as tanker drivers strike
Nigerians queue for petrol station because of fuel shortage sometime ago. / Reuters
8 Septemba 2025

Nigeria go likely begin to see fuel scarcity any moment if goment no settle palava wey dey between the Petroleum Tanker Drivers and Dangote Refinery.

Di tanker drivers wey be members of di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) declare strike because say Dangote Refinery wan use 4,000 new trucks wey dey run with gas (CNG) to carry fuel give pipo directly wey go sideline dem.

NUPENG talk say this plan go make plenty pipo lose dia work and e no allow workers form union.

Di Minister of Labour and Employment, Muhammad Maigari Dingyadi, talk say im ministry invite all of dem for meeting for Abuja to settle di matter.

He beg NUPENG to stop di nationwide strike, and e also beg Nigeria Labour Congress (NLC) to withdraw di "red alert" wey dem give oda unions.

"I beg di unions make dem gree make peace dey. I promise dem say we go settle dis matter well well," Dingyadi talk for statement wey im spokesperson, Patience Onuobia, sign.

Check out small sample of TRT Global! Share your feedback!
Contact us