Ethiopia don sign agreement wit one unit of Nigeria Dangote Group to build $2.5 billion fertiliser factory, Prime Minister Abiy Ahmed tok dis one for Thursday for im post for social media platform X.
Abiy tok say di deal wey dem sign wit Dangote Group, wey Africa richest man, Aliko Dangote, own, go make Ethiopia join di big fertiliser producers for di world.
Di factory, wey dem go soon start work for di site, get capacity to produce up to 3 million metric tonnes of fertiliser every year, di prime minister tok.
Africa dey currently import over 6 million metric tonnes of fertiliser every year, na wetin Reuters news agency report.
‘Reliable supply’
“Dis project go create work for di people wey dey here, e go make sure say our farmers go dey get fertiliser wey dem need, because dem don dey face wahala for long, and e go be big step for our journey to food independence,” Abiy tok.
For June, di Nigerian billionaire bin tok say Africa go fit produce di fertiliser wey e need by itself within 40 months, based on di expansion wey dem dey plan for im $2.5 billion factory for Lagos, Nigeria commercial hub.